View all from Ruggedman
Enable Javascript and Adobe Flash player in your browser to browse the full media galleryThy album comeRuggedmanEnglishhttp://www.youtube.com/watch?v=9Qq8LzMJYrQMichael Ugochukwu Stephens2006
Intro (talking)
Verse 1
Just because I open my mouth
People dey hala, people dey shout
Them dey kolo both for streets and inside the house
Including universities, polytechnics, respect me
Because I don yarn wetin them don keep inside them chest since
I speak for shoemakers
I also speak for mechanics
I speak for those wey hear some kind of rap and don't understand it
I speak for those wey don vex so they dem tear them clothes
And for those wey no fit talk unless Oga door don close
I speak to those wey dey ask me where I don dey since
While I pity ones wey enter rap without knowing the basics
Makes it da real or fake rubbish
Because makeshift- no dey last- na Matrix
Like actors wey dey waka pass
I teach through my music, give you lesson to learn
No matter wetin them try to do, my fire still go burn
I don speak ma mind and I go still speak more
You either love me or hate me in peace or war
Chorus (talking)
Verse 2
Some actually ask why I spat the way I did with so much venom
Say if I no get beef why I no just call them to tell them
How you go talk to person wey he dey feel say him dey too much
When ofcourse we know say the cause na plenty promo from big bros
Of course I laid low
Watched the fake glow grow
Prematurely, I knew it had to end for surely
It was insults
I took with a pinch of salt and a bottle of malt
Until the voice in ma head say
â€Na time to put a halt toâ€
Da fake hype, fake promo ,fake rap
Them don too believe that's why e be like say I set trap
Wey them fall inside as I glide
Rush to wash all of them like bar beach high tide
Those flows came from inside
My brain, wey them don dey try to stain since
Like puttin white cloth inside a bowl of paint or blue ink
I don speak ma mind and I go still speak more
You either love me or hate me in peace and war
Chorus (talking)
Verse 3
My time na wetin I take to go investigate
And drop flow wey everybody go fit relate with
Children go fit to play with
Hit da stage with
Trip and split your brains with
Because its filled with facts wey go make you flash back to past tracks to criticize
Here, take eh heh, put am inside
Make you feel the words, make you feel the vibes
Eedris yack Tetuila with in leg, nobody talk
I name names and criticize lyrics, them crow like cock
They run around like chicken wey them cut in neck
Some no fit wey for while others dey wait for wetin I go talk next
Another- send me mail dey analyze ma lyrics
They pick out points from deep inside-I was tripped
Now I don turn one man fan to ma own critic
Which also makes you ma fan whether or not you admit it
I don speak ma mind and I go still speak more
You either love me or hate me in peace and war
Chorus (talking)
© Ruggedman
Watch the Peace or war video by Ruggedman
Produced by Rugged Records













Poster un nouveau commentaire