Iya Basira - Museke African song lyrics

Tagged:  •    •    •    •    •    •  
  • Iya Basira
    Enable Javascript and
    Adobe Flash player in your browser to browse the full media gallery

    View all from Styl-Plus
    Expressions
    Styl-Plus
    English
    5:14
    http://www.youtube.com/watch?v=s8BCj3USAAY
    Shifi Emoefe, Tunde Akinsanmi, Zeal Onyecheme
    2006

Talking

Dis na one buka wey I dey like to go
The food sweet so tey e go make your mind blow
Day and night, Iya bass
How she do am I no no
Dem tink say na jazz, my brother no be so

Chorus
People, people, make una come e oh
Iya basira e don jazz me oh
Oh oh oh
Everybody helep save me oh
I no dey sabi chop either my mother or my girlfriend's food
People, people make una come e oh

Iya basira e go kill me oh
Oh oh oh
Everybody helep save me oh
I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food

Verse 1
No be so
I say na food go kill you
Wetin dey
Be say e get one day
Wey I say I go play go see my paddy Sunday
Na so I reach there but Sunday he don high on beer
Luckily for me in junior brother eye e clear
So e say make we stroll through the area
Little did I know I was strolling to my burial
right there where Oshodi bus dey load
Was a little buka, close to the main road
I laugh when e pass the door
He tell me say the name na “Iya Bas” for short
But I bow when he order
“iresi ati ewa, eran umum” pure water not even minerals
I come gree say I go manage to chop am
Before I realize I dey order second round, third round, fourth round
I never still stop wetin Iya Basira e give me chop
<!--[if !supportLineBreakNewLine]-->
<!--[endif]-->

Repeat Chorus
<!--[if !supportLineBreakNewLine]-->
<!--[endif]-->

No be so
I know, na food go kill you

Verse 2
You think say na play
When I say that the way wey I dey (wetin do am?)
E no dey okay
Wetin be your own advice
I don dey steal my paddy money to buy Iya Basira rice
Even on my girlfriends birthday
Wey she dey wait make I take am to Ocean View
I no know when I pass di place
The only thing wey dey my mind na Iya Basira's palm oil stew
Kilon kilon sele sele
Me I never see this kind, juju tele tele
All those people wey go vex pele pele
But I hear say iya basira na bele bele
I sure say still I go go their go sit down
Order my first round
Move to second round, third round, fourth round
I no dey ever stop
Wetin iya basira don give me chop?

Bridge
Officer I beg, follow me to the place
Everybody don tell me I dey craze
My girlfriend don leave me
My mother no gree see me, my paddy
Hmm, Iya basira you don kill me
Officer I beg, follow me to the place
Everybody don tell me I dey craze
My girlfriend don leave me
My mother no gree see me, my paddy
Hmm, Iya basira you don kill me
<!--[if !supportLineBreakNewLine]-->
<!--[endif]-->

Oya, people, people, make una stop, officer, e don come

Policeman: where the woman?
People: E dey inside

Woman: Oga, I dey come.
Policeman: Woman na wetin you dey give people chop
Wey dey cause all this wahala
Casala oya make we talk.
Woman: Oga sir, true to God
Nothing wey I dey put for the food wey I dey cook
Na God dey make am good
Policeman: Na which kind talk be that
Say na God dey cook the food
Abi you think say I be fool
No be juju you dey put?
In fact, I dey suspect say na you wash put sotey
People dey queue come dey rush for your stew

Well, to confirm am
Me I no mind make I chop small
Give me fufu ninety naira plus dat soup wey dey draw
Chai, correct!
This food sweet no be small
She una no go vex if I still order for more

Woman: Officer no worry na de food be dis

Policeman: Oya, people, people, make una go case dismissed

Repeat Chorus till fade

© Styl-Plus

:

Watch the Iya Basira video by Styl-Plus

 

Produced by Sunky and Mekoyo

Sarpong's picture

This song is so true. The way me and my friends like that waakye seller down the road from our house paa eh. I mean even J J Rawlings likes them, Mr. yoke gari.

Kevin's picture

Ths song is funny

guest's picture

bukateria! i miss the buka, when shall i go home and enjoy some? styl-plus na the best for nigera now, zeal, shifi, tunde, keep on doing your thing

Rashid's picture

funniest song I have heard in awhile. big up styl-plus
the best food comes from Africa as y'all know, y'all shdnt even front cuz if you do, you tripping real bad

Poster un nouveau commentaire

The content of this field is kept private and will not be shown publicly.
  • Lines and paragraphs break automatically.
  • Youtube and Google video links are automatically converted into embedded videos.

More information about formatting options

1725.44